Nigeria deny signing di EU-ACP agreement on LGBTQ

Pesin dey hold gay pride flag

Wia dis foto come from, Getty Images

Nigeria neva sign di New Partnership Agreement between di European Union and kontris wey dey part of di Organization of African, Carribbean and Pacific States (OACPS).

Di Federal goment of Nigeria reveal say nobody bin represent dem for di signing of di New Partnership Agreement between di European Union and kontris wey dey part of di Organization of African, Carribbean and Pacific States (OACPS).

According to statement wey di Ministry of Foreign Affairs bring come outside di goment say "di general public dey invited to note say Nigeria bin no dey represented for di signing ceremony wey hold for Samoa for Wednesday, November 15, 2023 and so neva sign di agreement."

Dem add say, "relevant Nigerian stakeholders dey currently look di instrument to make sure say wetin dey inside no go against Nigeria domestic laws."

Skip Twitter post
Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post

Dis signing document bin turn wahala afta di Chairman of di Human and Constitutional rights committee, Sonnie Ekwowusi bin hala make goment press pause for di mata.

For interview wit local tori pipo, e tok say, "we dey tok say dis no fit happun becos LGBT dey illegal for Nigeria. Why go den turn to sign document wey get sometin to do wit di promotion of LGBT rights?

"E dey completely unacceptable and make we no sign, make Nigeria tok no, Namibia and Ghana don tok say dem no go sign".

To put more fire for goment bum-bum Barr Ekwowusi reveal say, "dis document go lead us to our early graves, sake of say wen we sign, we dey sign our death warrant."

Numbers neva comot of how many member states representatives on top di new agreement.

Although dem no clearly mention sexuality, di document bin tok against discrimination for any reason.

Di agreement bin also tok say "di parties go commit to to sexual and reproductive health and rights in di contest of di Beijing Declaration and Platform for Action and the Programme of Action of the International Conference on Population and Development".

Critics for di signing of di agreement say di use of "sexual and reproductive health and rights" dey based on one WHO document wey dem call "Sexual Health Human Rights and di law" wey tok about abortion, LGBT rights, same-sex marriage, transgender surgeries among odas.

Wetin dis ACP-EU Partnership be sef?

Picture for di signing ceremony

Wia dis foto come from, OACPS

According to di European Commission, dis ACP- EU partnership na one of di oldest and most comprehensive frameworks between di EU and third world kontris make dem fit collabo.

Di members na di 27 member states of di EU and di 79 members of di OACPS wey include 47 African kontris, 16 Caribbean kontris and 15 Pacific kontris wey include di Republic of Maldives.

Di agreement wey suppose dey signed by member states evri 20 years.

E bin start for 1963 unofficially as collabo for economic and social infrastructure between 18 African States and six European kontris.

But no be until 1975, wey dem sign di Georgetown Agreement wey stamp di OACPS group.

Den di Lome Convention wey bin dey signed by 46 ACP kontris and 9 European states na di first collabo between ACP and Eu.

So far dis two organisations don sign six of these agreement and di 2000 Cotonou Agreement bin suppose last only till 2020 but condition shift am to dis time.

Wetin dey inside di document

Di Samoa Agreement na 403 page document wey list di areas wey di European Union and Members of di OACPS go follow collabo.

Dis also include di way each of di regions go take partner wit di EU.

Di agreement na all-inclusive legal framework wey go cover di two parties relations for di next 20 years.

According to di EC, di tok-tok on top post Cotonou Agreement, di old one wey Nigeria bin sign, bin don start since 2018.

Di new agreement cover tins like human rights, democracy and governance; peace and security; human and social developemt; inclusive, sustainable economic growth and development; environmental sustainability and climate change.

Last of all, most especially with di way pipo don dey japa dis days, di EU and OACPS bin also cover migration and mobility under dis framework.